Nigerian takes power for USA

 

Adewale Adeyemo: US President-Elect Joe Biden nominate Nigerian born 'Wally' for Deputy Treasury Secretary - See who im be

Adewale Adeyemo

America President-elect Joe Biden don nominate Nigerian born lawyer Adewale Adeyemo as di Deputy Treasury Secretary of di United States.

Adewale Adeyemo alias Wally wey confam di nomination for im Twitter handle say "As Deputy Treasury Secretary, I look forward to helping us build back our better economy."

Oga Wally na di former senior international economic adviser to di former US president Barack Obama.

He go serve under di former Federal Reserve Chair Janet Yellen, wey be di President-elect nominate as im Treasury Secretary.

If senate confam her, she go be di first to ever hold di position.

Oga Biden transition team say im picks for senior economic roles go help "lift America out of di current economic downturn and build back better".

Adeyemo appointment na one of di many ogbonge cabinet positions Biden dey expected to announce soon.

Who be Adewale Adeyemo?

Dem born Adewale Adeyemo alias "Wally" for 1981 for Nigeria but he grow up for California.

E obtain im Bachelor degree from University of California, Berkeley before e go Yale Law school for im legal education.

Before e begin work under Obama administration, Adeyemo bin first work as editor for di Hamilton Project, den work as senior advisor and deputy chief of staff to Jack Lew for di United States Department of Treasury.

He later work as di chief negotiator for di Trans-Pacific Partnership and also serve as di first chief of staff of di Consumer Financial Protection Bureau under Elizabeth Warren.

For 2015, dem appoint am to serve as Deputy National Security Advisor for International Economics and deputy director of di National Economic Council.

He later become di first president of di Obama Foundation.

Comments

Popular posts from this blog

Stamford Bridge Collapse at Goodison Park as Everyone defeat Chelsea to end a long.....

Road Block in Armenia

Salah Kisses Covid-19