The Superflop of Nigeria in a mess of SeriousLeone

 Nigeria vs Sierra Leone: Super Eagles play 4-4 wit Leone Stars for dia Afcon qualifier

one hour wey don pass

Victor Osimhen score Nigeria third goal against Sierra Leone

Sierra Leone come from four goals down to play 4-4 draw wit Nigeria for dia group L, African cup of Nations qualifying match wey happun for Samuel Ogbemudia stadium for Benin City on Friday.


Nigeria wey take di lead through Alex Iwobi inside five minutes been control di game for first half wit goals from Victor Osimhen,Samuel Chukwueze and anoda from Iwobi to go 4-0 inside 31 minute.

Nigeria vs Sierra Leona Afcon qualifiers - See how di game go be

But Sierra Leone pull one goal back from Kwame Quee four minutes before half time.

For second half di visitors score three goals two from Alhaji Kamara and Mustapha Bundu wey put di Super Eagles under serious tension to make am 4-4.

Di result mean say Nigeria dey sidon ontop group L wit seven points followed by Benin, Lesotho and Sierre Leone.

Dem go play di return leg against Leone stars, on Tuesday November 17, for Siaka Stevens stadium for Freetown, Sierra Leone.

Na only di top two teams go qualify for di tournament wey go happun next year for Cameroon

Ahead of di match Nigeria Football Federation bin announce say all di players test negative for Covid-19.

Last Month during di international break Nigeria play two friendly games wia dem lose to African champions Algeria and play draw wit Tunisia.

Although most of dia key players bin dey injured for di match.

Who start for Super Eagles?

Victor Osimhen, Joe Aribo and Oghenekaro Etebo all start for Super Eagles but Leicester City Kelechi Iheanacho wey score for dia last match against Tunisia start from bench.

Comments

Popular posts from this blog

Stamford Bridge Collapse at Goodison Park as Everyone defeat Chelsea to end a long.....

Road Block in Armenia

Salah Kisses Covid-19